Xplain Am
@XplainAm_
This page go dey explain the economy in a way wey my mama sef go fit understand. No forget. We dey learn together.
15/04/2025
> Reason 4: Bad roads + Wahala on the way
Make we no lie, the road wey connect farmers to market bad well.
Sometimes trailer go fall, food go waste.
Then insecurity — kidnappers, bandits — dey make drivers fear.
So them go increase transport money or no go at all.
All these stress go enter price. And who go suffer am?
Na you wey wan buy pepper for ₦200, dem go tell you ₦800.
13/04/2025
FOOD JUST DEY COST ANYHOW?
Reason 1: Naira don fall
Naira wey dem dey take buy food from outside don lose value.
Before, 1 dollar fit be ₦500… now e fit reach ₦1,300 or more!
So if bread ingredient na $1 before (₦500), now na ₦1,300.
That same bread go cost more for market.
We go explain why Naira dey fall soon.
But just know say, once naira fall, food price dey climb.
Reason 2: Fuel Wahala
Make we no lie, transport na bloodline of food price.
If farmer harvest yam for Benue, dem go carry am come Lagos.
Fuel cost go affect how much e go reach here.
Before, dem fit use ₦20k fuel. Now e fit be ₦60k.
That extra money go enter food price.
Na why you dey buy the same tomato for double money.
Fuel matter no be beans. Na one big reason why food dey cost!
Click here to claim your Sponsored Listing.
Category
Website
Address
Abuja