Ughelli Aproko Gist
Ughelli Aproko Gist Na Where We Dey Bring Una First Hand Aproko Gist.
10/06/2026
The Department of State Services (DSS) don alert Edo State Government say bandits dey plan to carry out mass kidnapping of school children for the state.
As we dey hear with one ear now say Edo state government don close schools cos of this uodate wen DSS give them.
Delta State Government make una sit tight cos edo and delta na twin states and na water wen touch penñîs nai touch brokos ooo,
Update On The Issue Of Oghenemine When Ogbegbe Kpai.
Police don successfully track and parade four people when know and link to the g^n matter.
Make una nor forget say the former police officer wen shuuut Oghenemine kpai wen dem dey call Ogbegbe and four others don dey Ogwashuku prison.
We dey use this medium to commend Nigeria Police Force for this one and also to beg dem make dem also track those b@nðIt and HeRďsmen wen dey worry the country.
09/06/2026
Our local government chairman don pay one woman rent for ughelli oooooooooo.
According to the story, the woman wen her name na Mrs Elisabeth Christian na originally from benue state.
Na the Senior Special Assistant (SSA) on Special Duties to the Council Chairman, Emuophedaro Igho nai represent olorogun Egbo and he pay the house rent directly to the woman landlord.
Click here to claim your Sponsored Listing.
Contact the organization
Website
Address
Ughelli